HOW WE WAN TAKE THANK GOD FOR THIS ONE NA...NA TO SHOUT GOD YOU TOO MUCH......................

. Na how I wan start swagP? my name na Swag Dinma from Benin Dis kyn testimony dey good 4 pigin. Thank God sey I follo do d 2am back 2 sender throwing of arrow. Wait first, make I first dance..º°˚˚˚°º skelewu º°˚˚˚°º \=D/ \=D/ . SwagP, u remember last week friday sey I ping u dey cry sey I dey get contraction at 15weeks pregnancy. Naim I com go do scan, d sonographer sey I dey dilate n I need to see my doc urgently make dem 4 fit tie my womb so dat I no go miscarry. SwagP, na with faith join with ur faith I sey I no go meet doc 4 dat surgery. D respond wey u even give me wen I tel u, make me more gallant in my faith,you sa lie lie i no go do surgery or miscarry make i throw arrow of miscarriage fast back to sender high high one say no way same my baby na testimony say make i gallant no shaking doctor report go change ,say i be swag. Na so I begin throwey d arrow of miscarriage by 2am. God, I sey God no dey fail im pipu. 2day, I com go do a re-scan to spy or peep if everything dey normal or yawa don gas, na so d sonographer jus dey praise me sey I dey really eat healthy cos my baby de bounce n de play with d umbilical cord n dat make i  pls stick to d diet I'm on sey everytin dey ok n good huh which diet na Arrow me throw i talk dis wan for my belly. He also confirm sey d service no dey like wetin dem say e been dey dilate oh see shock for their eye how ova nite my baby stay well. Swags sisters, ain't it Christ? Benin swags, shoooooo! no b God? Swag p kie God vessel..i meet you 4 shift time oh i no say my mystery request no fit turn to bad news na i be swag wit my baby. God bless u 4 doze words of encouragement and the  imediate back to sender you talk as i tell u . U're a blessing to ur generation. In all, I thank God 4 his sufficient grace upon my life. He alone is worthy to b praised. One arrow confirm am i go soon still testify more soon. Azonto \=D/ \=D/ º°˚˚˚°make una no de gree doctors report o chaii.

Comments

  1. Swag Dinma i rejoice with you oh but next time no de dance skelewu or azonto for blog ....dance THIS KIND GOD O....am so happy for you.

    ReplyDelete
  2. Thank God for not letting the doctors report come to pass. Praise the lord.

    ReplyDelete
  3. I celebrate with u My swag sista, u go continue 2 dance all tru and u go born gidigba cos baba God don seal am. God make u continue 2 bless swag P. Swag ngozi

    ReplyDelete
  4. Lol @ skelewu I almost talk am o. Ok ds kind God o I neva see Ya type o blessed be Ya holy name. Hummm me na 6yrs na I still dey find the bele but ds ya testimony is encouraging & I decree & declare say tru ds ya testimony my seed & tithes no go fall for ground swag ground is fertile I must testify it is my turn oooooo swagp I no no how we wan do am but come june 29 I must testify enough is enough o FIREEEEEEEE in Jesus name Amen! Swagp God neva begin reward u sef. God receive all glory

    ReplyDelete
  5. Lolzz! Praise God for u my dear sis

    ReplyDelete
  6. Chai deris God oooo.God of miracle.I rejoice with you.

    ReplyDelete
  7. Baba God u too much!! U no fit fail!!! Thank u Lord for dz miracle.

    ReplyDelete
  8. @ swag inikpi me too sure for your own 6years don do but God go use 9month show you say devil na fool..yes i agree with you say come 29th u go de with quadruplet nor just worry e go happy....God don approve am.

    ReplyDelete
  9. Yes o, swag Dinma na only impossible things dis our God de like do for us o. Congratulations in advance o we must celebrate it must end in praise. I tap dis one for my friend mrs Gana she sef must testify of her babies as the Lord lives

    ReplyDelete
  10. Thank God ooo. He is indeed the greatest physician.

    ReplyDelete
  11. Swag Dinma, i rejoice with you. God is Faithful

    ReplyDelete
  12. I rejoice with you my dear. .

    ReplyDelete
  13. Halleluyah!!! God is the almighty indeed

    ReplyDelete
  14. Jehova d wonder worker. ..... God ll bless nd keep u nd d baby IJN

    ReplyDelete
  15. Who is the doer of all this if not God? I just thank him for this

    ReplyDelete
  16. OH MY GOD!!!!!U TOO MUCH,U RE INDEED A GOD OF WONDERS,Swag 4 life oooooo

    ReplyDelete
  17. God is too faithful to fail.i rejoice with u my. Fellow swag sis

    ReplyDelete
  18. You alone are God, you are God all by yourself. God be praised.

    ReplyDelete
  19. Marvelous God, who said none shall be barren in our midst. I thank him for the victory he gave u over d enemy. You shall carry fullterm and no power can stop that in jesus' name Amen. May God continue to bless his servant (SWAG P) with an increase of his annointing. Amen

    ReplyDelete
  20. Wat a gud God,swag Dinma i rejoice with u n also thanking God 4 proving ur enemies wrong!God is indeed faithful,swag p may God continue 2 bless n also use u 2 prove 2 d world dat he's answering by fire!

    ReplyDelete
  21. I rejoice with you . Praise be to Almighty God.

    ReplyDelete
  22. Because u are on the throne,all will be well

    ReplyDelete
  23. I rejoice with you swag Dinma.God is truly great, and will perfect what he started in ur life and for every1 hoping on him for d fruit of the womb

    ReplyDelete
  24. Thank you father Lord is this Amazing testimony, I give u all the glory oh! Lord.....

    ReplyDelete
  25. Only God de run am.... Morris. O .

    ReplyDelete
  26. I rejoice with you swag Dinma,may the name of the lord be praised forever more Amen. I tap annointing from this testimony and I pray that the God of swag p open my womb by fire in Jesus name Amen

    ReplyDelete
  27. *God Of Miracle; Na My Papa Ooo ....I Over Happy For You Oh Swag Dinma; The God Wey Start This Awesome Turnaround Go Perfect Everything He Start ....We Must Come Rejoice/Jollificate With You In Jesus Name ....Make God Continue To Use Swag P Take Dey Bless He People Oh ......God Too Much Jor

    ReplyDelete
  28. GOD IS GREAT, HE IS WORTHY TO BE PRAISED,..I TAP INTO ALL THE AWESOME TESTIMONIES ON THIS BLOG COS I KNOW I SHALL TESTIFY SOONEST!!!.

    ReplyDelete
  29. The Lord is still the gracious. Congrats sis. My time is now

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular posts from this blog

AM STILL IN SHOCK...BUT NA THE WAY MY GOD DE DO IN THING....WOW

THE POWER OF THE MYSTERY SEED AND HOW TO MAKE YOUR MYSTERY SEED ANSWER AND WORK FOR YOU.....

2KINGS 3:17 .....GOD PROVED HES WORD TO ME .MY ENEMY PLAN 6FEET BUT MY GOD TELL THEM SAY THEY NO REACH HAHAHA